OBODO NAIJA

Peter Obi Say Make Gornment No Chop Subsidy Money

todayAugust 25, 2026 4

Background
share close

Di Nigeria democratic Presidential candidate, Peter Obi don distance himself for dis fuel subsidy mata say mismanagement of money by di current gorment nor mean say make Nigeria return back to subsidy.

Im fire fire dis mata  during sit down tok tok inside di Nigerian Bar Association Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State.

Di presidential candidate of NDC say hin support removal of subsidy, but gornment suppose use di money wey dem recover provide better alternatives for Nigerians instead of allowing corruption and mismanagement.

However, Omoyele sowore scata table as begin accuse im opposition particularly ADC dem don enter gorment and fail B4, ngwanor, na so Ameachi wey rep di ADC fire back

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds