OBODO NAIJA

Nasarawa Gofnor Order Torchlighting Untop Missing Hospital Tins

todayAugust 27, 2026 6

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Nasarawa State Govo, Abdullahi Sule, don order immediate torchlighting into reported missing mattresses and fans wey dem donate to Umaisha General Hospital for Toto Local Government Area.

Di  matter come up after lawmaker representing Umaisha/Ugya constituency for Nasarawa State House of Assembly, Sa’ad Abdullahi, raise alarm say hospital staff no fit account for some medical items wey e buy and donate to di facility.

Di lawmaker, wey be member of APC, visit di hospital to check di condition of di facility and find out how dem dey use di item wey e donate to support hospital operation.

Di donated items include 50 hospital mattresses, 50 ceiling fans and 40 standing fans.

Govo Sule don now direct authority to torchlight di matter and find out wetin happen to di missing item.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds