Nigeria Democratic Congress House of Representatives candidate for Esan North-East and Esan South-East Federal Constituency, Edo State, Akhakon Anenih, don come outside point finger give police say dem nor do anything when jaguda boys attack dia pipo for Benin City yesterday.
Di politician make dis allegation today, Thursday, November 26, 2026 for one siddon tok wit tori pipo after e follow di victim wey wunjure for di kasala yesterday.
According to wetin Anenih tok, di officers nor move body to stop gbege.
Di attack happen yesterday November 25th 2026 as party members gather to welcome di NDC presidential candidate, Peter Obi, for town hall meeting for Edo.