OBODO NAIJA

Dino Melaye Blast Tinubu Over Five New Presidential Aeroplane

todaySeptember 1, 2026 1

Background
share close

By: Mariam Ajayi

ADC chieftain, Dino Melaye, don blast Presido Bola Tinubu gorment over di reported addition of five new aeroplane to Nija Presido Air Fleet for less than four years.

Melaye make di statement for X, e describe di increase as ridiculous, say country wey e say still dey struggle with poverty.

Di former Kogi West Senator also complain say Nigerian Air Force no even receive any new aircraft throughout 2025.

Melaye say di reported five new aeroplane under Tinubu gornment be record-breaking figure, especially when compared with di situation of di Nigerian Air Force.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds