OBODO NAIJA

Wike Say Abuja Residents Life Better Under Tinubu

todaySeptember 2, 2026 1

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

FCT Minister Nyesom Wike say di quality of life for Abuja residents better under Presido Bola Tinubu gorment.

Wike make di statement during media chat for Port Harcourt, as e respond to criticism over gorment performance, saying Nigerians no suppose judge better life only by house ownership.

E say di rail system wey no dey work before don get attention from gorment, while different roads across Abuja don receive rehabilitation and construction.

Wike add say quality of life pass owning house, because not everybody fit afford house, as better transport, good roads and infrastructure also dey make life easier.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds