By: Damilola Adekunle
Peter Obi don call on Naija leaders and citizens to join hand together rescue di country from poverty, hunger and insecurity ahead of di 2027 presidential election.
Obi make di call on Monday for Abuja, where e attend di commissioning of Oyo State Gofnor Seyi Makinde 2027 presidential campaign office.
Di former Anambra gofnor say Makinde qualify to contest for presido, adding say whoever Naija choose through credible election deserve everybody support to build better country.
Obi say dem no dey desperate for power, but want Najia to freely choose dia leader and everybody come together to build a new Naija.