By: Mariam Ajayi
Dis Ebola virus nor get same for eyes oh, see di way e dey rush DR Congo, you go sorry for dem.
Infact United Nations dey scream, help oh help for DR Congo, say na over 3,200 pipo don kpeme, and like dis health workers dey sweat like person chrismas Goat, e nor easy.
According to UN tok-tok person, Stephane Dujarric, To pull di handbrake on dis badness, WHO and DRC gornment don raise hands beg world powers make dem drop $1.3 billion quick-quick to boost treatment and stop di spread.