OBODO NAIJA

Akpata Say AI No Fit Replace Courtroom Argument

todaySeptember 11, 2026 4

Background
share close

By: Damilola Adekunle

Olumide Akpata tok  say pipo wey wan succeed for law must sabi build strong argument and convince pipo, as AI no fit replace human courtroom skills.

Akpata, wey be di 30th President of NBA, tok dis for Port Harcourt for di NDDC 2026 Moot and Mock Trial Competition for law students across Niger Delta universities.

E commend NDDC for di competition and tell universities to establish moot courts to help law student build confidence and beta prepare for di profession.

Akpata tok say even as technology and AI dey grow, di ability to stand for court and argue against something wey pipo ,no expect na skill machine no fit give lawyer.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds