By: Mariam Ajayi
Lagos Waste Management Authority, don warn say anybody wey buy goods from traders wey dey sell for road go face arrest and prosecution.
LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, announce dis for im office, say di new enforcement go target both illegal traders and pipo wey dey buy from dem.
E explain say di action dey follow Section 151(2) of Lagos State Environmental Management and Protection Law 2017, wey make am offence to buy goods wey dem dey sell for prohibited places.
Gbadegesin tuk say di measure na part of renewed effort to stop illegal trading, indiscriminate waste disposal and blockage of public infrastructure across Lagos.