obodo oyinbo

UN Blow Alarm As Ebola Kpai 3,500 Pipo For DR Congo

todaySeptember 16, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

United Nations Ebola Coordinator, Julien Harneis, don raise alarm over di way world pipo dey handle Ebola mata, as di virus don reportedly kill about 3,500 pipo for eastern DR Congo.

Di UN boss porporly dis mata for news statement on Tuesday, say if dem leave Congo, ehn, ehn, Ebola go finish Congo, and dat dem need beta help.

Oga Harneis con kneel down dey  beg world pipo, say if na money oh, medicine any kind of support make dem send am to Congo, as di story dey worwor everyday.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds