E don red yo, Okpebolo promise, na di pipo dey hear am, like dis na Esan West LGA Chairmo, Oga Blessing Ebhodaghe don order transport drivers for Edo State, say dem gat wear APC caps, cause any kpoko, di person go chop fine.
Ebhodaghe give dis order on Thursday for motor park to hellep baba Govo, Monday Okpebholo, gather 2.5 million votes give Presido, Bola Tinubu for 2027 election.
Di LGA boss warn say e go pursue any driver wey wear another party material commot for park instantly without caring about friendship.