OBODO NAIJA

Tinubu Absent For Unga Don Raise Question

todaySeptember 21, 2026 3

Background
share close

By: Ayobami Dada

Presido Bola Tinubu no go attend di 81st UNGA for New York dis year, as Vice Presido Kashim Shettima go represent Naija.

Hin absent go be the third time and some political opponents don dey use am to their advantage dey tok wetin no good untop the matta

But Tinubu’s Senior Special Assistant on Foreign Affairs and Protocol, Ademola Osodi, wey appear untop television interview on sunday tok say di President absence no go affect Naija international role

When the presenter press hin neck wellwell say him opponents especially Atiku Abubakar say na because of the gbege wey him get for America na hin make am dey fear, na there Osodi provoke say na belle politics sey worry the opponents

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds