Lagos State Gornment don carry new style enter mata, bring ogbgongelicious law way dem wan use rasckal sexual and gender based violence.
Na area Mama of Lagos, first lady, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, carry mata for head power dis law on Thursday, she porporly marras say, di policy na proper jazz to hold wicked for pipo neck for house, school, and office.
To tell how e serious reach, Ibijoke carry microphone swear say, she nor go take anything sexual and gender jaguda doings , say di tin na danger public health and human rights.
Read more tori for here:Â https://konfamfm.com/lagos-gornment-gbab-one-man-wey-allegedly-abuse-toddler/