Lagos

How Badagry Road Askident Roast 8 Pipo

todayNovember 27, 2026 6

Background
share close

Serious kasala na im burst for Thursday morning for Badagry Expressway around Checkpoint Bus Stop as fire roast eight pipo like suya, after one Mazda bus go jam culvert.

According by report di driver  driver lose control, say  brake fail am for road, na so di bus throw backie, catch  fire.

Na di Oga for Lagos State Emergency Management Agency, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, dey clear tatafo pipo dis mata say na serious overspeeding and wawa driving cause di askident.

Even  with di fire, rescue team sti  manage drag five adults, four men and one woman comot inside the burning motor, rush dem go Badagry General Hospital for sharp-sharp treatment.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds