By: Mariam Ajayi
Special Criminal Court for Edo State don sentence four pipo to death over dia role for di kidnapping of one woman for Vegetable Market, around Airport Road for Benin City.
Justice Aigbona Momodu give di judgment on Tuesday after dem face 11 charges wey include kidnapping, planning crime together, armed robbery, cultism and illegal possession of guns.
Di court wey Gofnor Monday Okpebholo set up na to handle kidnapping and cultism cases for Edo State.
Di four pipo wey receive di death sentence na three men and one woman, Marvelous Isaac, 32; Wisdom Michael, 36; Rufus Michael, 30; and Gift Raphael, 27.