By: Mariam Ajayi
INEC don tok say one announcement wey dey waka online about governorship candidates for six states na fake.
Di commission tok am on Monday for dia social media, say dem no release any list for Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano states.
INEC tell Nigerians make dem no mind di announcement because na fake news, e no come from dem.
Dem beg Nigerians make dem no share di fake news, make e no go dey spread lie about election.