OBODO NAIJA

APC, APM Dey Drag Each Other On Top Billboard Mata

todayOctober 14, 2026 6

Background
share close

APC campaign team for Senator Sharafadeen Alli don point finger at supporters of APM Govo candidate, Bimbo Adekanmbi, say na dem damage Alli and im running mate, Soji Adedeji, billboards for different parts of Ibadan on Wednesday.

APC say di damage happen for Mokola, Sango, Monatan-Olodo road, Odo-Ona and Toll Gate-Iwo road side of Lagos-Ibadan expressway.

But APM fire back, say APC dey lie, just to win Oyo pipu trust.

Both parties yarn dia own side for different statements from dia media spokespersons, Bisi Oladele and Yinka Oladoyinbo, for Ibadan.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds