Arsenal oga, Mikel Arteta, don tok say di first sign wey dem see for Bukayo Saka injury no make dem happy.
Saka come comot for pitch for di first half when Arsenal play 2-2 draw with Bayern Munich for Wednesday night.
Di Arsenal winger just fall for ground as e dey try kick ball cross di pitch give im teammate, and nobody touch am before e fall. Arteta come quickly bring Eberechi Eze enter di game to take Saka place.