OBODO NAIJA

Okonkwo Tok Say Tinubu No Fit Rule Nigeria

todayOctober 23, 2026 6

Background
share close

Kenneth Okonkwo, one of di leaders for African Democratic Congress, ADC, don tok say President Bola Tinubu no fit rule Nigeria.

E say since Tinubu enter office for May 29, 2023, na so so hunger and suffer choke Nigerians.

Okonkwo tok dis one for Abuja with tori pipo on Thursday, as e say food price don too cost, security wahala dey everywhere, sickness dey worry pipu, and many Nigerians no fit afford wetin dem need to survive.

Di Nollywood actor wey enter politics say Tinubu no get di body and leadership power wey Nigeria need, and e suppose comot for office.

E call on Nigerians make dem vote APC comot for next year election and choose person wey fit bring di country out of di wahala wey e dey face.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds