Sports

Harry Kane Win 2026 Ballon d’Or

todayOctober 27, 2026 6

Background
share close

How Harry Kane Take Win Di Award

Harry Kane don win 2026 Ballon d’Or. Bayern Munich striker beat Kylian Mbappé and Lamine Yamal to win di award as di best footballer.

Dis year 70th edition ceremony happen for London, on Monday and e make Harry Kane victory special because na London dem born am , and na di same city e start hin  football career.

Kane wey many pipu don dey expect to win di award arrive London with im family and plenty Bayern Munich officials.

Earlier for evening, dem name Harry Kane Attacker of di Year and give am Gerd Müller Award during di event for London Palladium.

But di Ballon d’Or na di biggest individual award wey e collect for di night.

Lamine Yamal also dey among di main man for di Ballon d’Or, but di Barcelona star settle for Kopa Trophy.

E win di award for best footballer wey never reach 21 years for di third year in a row.

But Yamal believe say im teammate, Pau Cubarsí, deserve di award pass am.

Yamal talk say, “Na im suppose win dis award because e dey play football for very high level.

Spain coach, Luis de la Fuente, and goalkeeper, Unai Simón, also win awards for London.

De la Fuente win Coach of di Year award after e lead Spain win World Cup, while Simón collect Goalkeeper of di Year award. Paris Saint-Germain win Team of di Year.

For di women category, Barcelona enjoy successful night. Alexia Putellas win Ballon d’Or Féminin for di third time for im career, while im teammate, Vicky López, collect Kopa Trophy for best young talent.

Dem name Cata Coll Goalkeeper of di Year, Barcelona coach, Pere Romeu, win Coach of di Year, while Barcelona win Women’s Club of di Year award.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds