OBODO NAIJA

Obi Drag Presido Tinubu Bad Leg Come out Say E Nor Get Energy

todayOctober 30, 2026 6

Background
share close

Nor be small voyolence everywia for dis 2027 election mata, Presidential candidate of Naija Democratic Congress, Peter Obi don drag senior man Presido, Bola Tinubu, leg come out again oh, say e nor dey fear God.

Which mean say Baba Seyi nor fit enter all 36 state to campaign for hin second term, but e get energy travel comot Naija  for over 260 days, say na only 36 days e nor fit take campaign.

Obi dey fire dis arrow as hin ma go Abakiliki, Ebonyi state go campaign.

U sabi say dis tok sef  dey come after Tinubu mention say him fit no enter all di 36 states go campaign, as governance need hin full attention.

Obi say na lie, na based on say senior man presido nor get energy naim make am tok like dat.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds