One man wey dem dey call Hamed Mirzaei tok say e don lose all e 12 members of im family after US-Israel attack hit one house for Tehran, Iran, on March 9, 2026.
Among di pipo wey kpai na im wife, 26-year-old Mohadeseh. E tok say him and e wife bin dey plan to start dia family before di attack happun.
He tok say e no get any reason to live again, e still dey go there Seven months after di attack, Hamed say e still dey return to di ruins of di building every day because e feel say im life dey buried there.
Hamed follow tori pipo tok today for siddon tok as e dey yarn e painful tori.