Politics

Atiku Supporters Mount Protest For Abuja Court

todayNovember 11, 2026 4

Background
share close

ADC candidates and Atiku supporters carry protest for Federal High Court gate for Abuja on Wednesday, November 11, 2026. Dem dey ask make court release official copy of judgment wey Justice Peter Lifu give on November 5, so dem fit carry di case go higher court.

Di judge cancel David Mark-led ADC leadership and all actions dem take, including nomination of former Vice President Atiku Abubakar as ADC candidate for 2027 Presido election.

Na former ADC deputy national chairmo, Nafiu Bala Gombe, carry di case go court, and di judge rule for him side.

For di protest, former acting ADC chairmo for FCT, Yusuf Tijani, tok say dem need di court paper before dem fit appeal. Dem claim say dia lawyer apply for di paper and pay di fee, but court registry never release am five days after di ruling.

Dem don write petition to di Chief Judge of di Federal High Court, John Tsoho, to ask make dem release di paper.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds