Lagos

LASTMA Rescue 17 Pipu As CNG Bus Catch Fire

todayNovember 12, 2026 5

Background
share close

Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don rescue 17 pipu after one commercial bus wey dey use compressed natural gas (CNG) catch fire following gas explosion along Lagos-Ibadan Expressway.

One other passenger sustain serious burn injuries inside di incident wey happen for Berger Bus Stop on di road wey dey enter Lagos.

Na LASTMA Director of Public Affairs and Enlightenment Department, Adebayo Taofiq, reveal dis news inside statement wey dem release on Wednesday.

According to LASTMA, di bus with  bin carry 18 pipu including di driver from Mowe-Ibafo area dey enter Lagos before di fire start.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds