Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don rescue 17 pipu after one commercial bus wey dey use compressed natural gas (CNG) catch fire following gas explosion along Lagos-Ibadan Expressway.
One other passenger sustain serious burn injuries inside di incident wey happen for Berger Bus Stop on di road wey dey enter Lagos.
Na LASTMA Director of Public Affairs and Enlightenment Department, Adebayo Taofiq, reveal dis news inside statement wey dem release on Wednesday.
According to LASTMA, di bus with bin carry 18 pipu including di driver from Mowe-Ibafo area dey enter Lagos before di fire start.