LASTMA

13 Results / Page 1 of 2

Background

south west

Accident Block Lagos-Ibadan Expressway As Rescue Team Clear Kara Bridge Scene

By: Esther Daniel Traffic movement don slow down for Lagos-Ibadan Expressway on Wednesday after oneĀ  accident happen around Kara Bridge area. Emergency responders begin recovery operation to remove di vehicle wey block part of di road, as motorists face delay while dem dey clear di scene. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) confirm di development through dia official X handle, say vehicles temporarily stop make recovery team fit carry out […]

todayJuly 22, 2026 16

Lagos

How Heavy Lagos Traffic Trap Drivers for Oshodi-Apapa Express

Nor be small tin sup for popular Oshodi-Apapa Expressway completely, say traffic show commuters and motorists beta shegge yesterday. According to aproko pipo say na di Nigerian Ports Authority (NPA), nor too coordinate tin naim cause di jogolo. Di whole expressway block after container trucks and fuel tankers line up anyhow to enter di nation’s busiest seaports and depots without any orderly arrangement.

todayJuly 10, 2026 11

Lagos

Bus Conductor Allegedly Nack LASTMA Screwdriver

Nor be small tin oh, say One bus conductor don go allegedly nack LASTMA official screwdriver for im head, wunjor am yangayanga for gorun for Abule-Egba, along Lagos-Abeokuta Expressway. LASTMA tuk,tuk, Adebayo Taofiq, na him bin sorosoke dis mata inside statement wey dem wrap like akara on Monday. Im explain dat di LASTMA official just bin dey do im job, na dis conductor wey head shake enter argument am, an […]

todayJune 30, 2026 15

Lagos

Two Trucks, One Car jam each odaĀ  for Gbagada Lagos State Traffic Management Authority

By : Jolayemi Olajide Nor drive wawa, wawa, pipo nor dey hear for di obodo lagos oh, like dis nowĀ  Lagos state Traffic pipo, don konfam one serious motor askident wey hapun for Monday morning insideĀ  Gbagada along di express. According to LASTMA, di askident involve two big trucks wey carry cargo and one private car, gbowayi, dem jam demselves. Di agency say emergency responders and tow truck don reach […]

todayJune 29, 2026 12

Lagos

LASTMA Rescue 353 Accident Victims

Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, don rescue 353 people wey involve for road accident and emergency cases across Lagos from January reach May 2026. LASTMA General Manager, Olalekan Bakare, naim tok dis one as e dey review di work of di agency Rescue and Emergency Response Unit. According to statement wey tuk, tuk person, Adebayo Taofiq release on Sunday, among di people wey dem rescue na 207 adult men, […]

todayJune 22, 2026 14

Lagos

Lagos-Apapa Expressway Askident Kpai Minibus Driver

One commercial driver don lose im life for serious askident wey happen for Lagos-Apapa Expressway. Di gboza crash, involve commercial tuke tuke motor and Toyota Tundra. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk tuk person, Adebayo Taofiq, di driver wunjure wetin nor gud and im kpai for di spot because of di heavy impact. Authorities don begin investigate to know wetin cause di askident.

todayJune 10, 2026 14

Lagos

Two Pipo Escape Death As Bus Somersault For Ogudu

By: Esther Ayoola Na God save two pipo afta one serious motor askident hapun today for Ogudu-Alapere area of Lagos. Dat one danfo and one big truck jam each oda ikpaaii. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA), na one 12-tyre DAF truck and Volkswagen T4 danfona get di askident. LASTMA officials wey dey patrol naim go di area, rescue di victims and control traffic movement to prevent more […]

todayJune 1, 2026 19

Lagos

Na 69 People Kpai For Lagos Road For First Quarter 2026 — LASTMA

Lagos State Traffic Management Authority talk say 69 people don die for road across di state for first quarter of 2026. Na di General Manager of LASTMA, Olalekan Bakare-Oki, drop di information during interview with News Agency of Nigeria (NAN) on Sunday for Lagos. Bakare-Oki still add say di authority clear more than 600 accident scenes within di period, and di authority also tuk say 246 oda people sustain different […]

todayApril 26, 2026 18

Lagos

Tanker Driver Run ComotĀ As E Kpai One Pesin For Lagos

One tanker driver don run comot after e motor jam one dispatch rider for Cele Bridge area along Apapa–Oshodi Expressway for Lagos on Wednesday. LASTMA tuktuk, Taofiq tok say di HOWO tanker wey carry diesel dey move when e jam di bike, crush di rider under di motor. Di impact strong well-well as di rider die sharpaly for di spot before help fit come. Authorities still dey find di driver […]

todayMarch 26, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds