OBODO NAIJA

 Jonathan Warn Pipo Make Dem No Start Tribe Wahala for Election

todayNovember 17, 2026 6

Background
share close
Before-before Presido Goodluck Jonathan don drag ear give politicians and Nigerians inside Abuja on Tuesday, November 17, 2026, say make dem stop political intolerance, thuggery, and tribal gbege ahead of 2027 general elections.
E drop dis heavy warning during one peace and security conference wey Goodluck Jonathan Foundation organize, where e beg everybody make dem put country unity front before dia personal political eye-red.
Jonathan tell citizens say make dem use 2027 election choose leaders wey sabi work well well for both state and federal level, instead of pipo wey just wan chop power.
E warn say anybody wey dey fan fire of tribal hatred because of election wan scatter di whole country, and if Nigeria break like clay pot for market, nobody go get place to hide!

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds