Police Oga, di Inspector General of Police, Olatunji Disu, don drag ear give young pipo make dem nor allow politicians use dem cause katakata as 2027 general election dey come.
Im give dis warning yesterday Sunday November 15th 2026, when im follow tori pipo tok for im visit go di village house of Govo of Abia State, Dr Alex Otti, for Isiala Ngwa South Local Government Area.
Di Police Oga press mouth say youths nor suppose allow politicians recruit dem as jaguda boys or use dem scatter di election process.
Im still beg parents make dem warn dia pikin dem well well so nobodi go use dem cause gbege during di election.
Inspector General of Police, Olatunji Disu, konfamate say police pipo don begin enforce di law and dem still dey educate pipo on how to behave peacefully ahead of di elections.