Sports

Online Jaguda Boys Don Enter FIFA System Colobi Personal And Business Information

todayNovember 26, 2026 10

Background
share close

World football governing body, FIFA, don konfamate say online jaguda boys enter dia system colobi some personal and business information.

One group wey call demself Handsome Boy Hacking Club claim say na dem do di work after dem post picture of FIFA files online.

Di hackers claim say dem carry twelve gigabytes of data, even though analysis show say di files nor reach zero point one percent of wetin FIFA get.

According to tori pipo, di attack happen because di criminals pretend like FIFA staff to wayo workers, nor be say FIFA computer technology fail.

FIFA drop dis konfamation today, Thursday, November 26, 2026, even though di exact day wey di attack happen nor still clear.

Even though di hackers enter FIFA records, tori pipo understand say dem nor touch any document about di controversial FIFA Forward Enterprise plan.

 

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds