All di 57 Local Gorment Areas and Local Council Development Areas for Lagos State don join body to build 114 new roads inside dia different communities, under one programme wey dem call One for All Road Project.
Di 57 councils dey work together under one umbrella body na im dem dey call Conference 57, dis group bring together chairmen of all 20 Local Gorment Areas and 37 Local Council Development Areas for Lagos State join bodi.
Chairmo of Conference 57 and Ibeju-Lekki Local Gorment Chairmo, Abdullahi Sesan Olowa, yarn dis one on Wednesday, November 25, 2026, during one siddon tok wit tori pipo for Ibeju-Lekki Local Gorment Secretariat, Igando-Oloja, Lagos.
Olowa explain say each council go build one road for di first round and another one for di second round, making 114 roads altogether.
Di work go include repair of bad roads, construction of gutters, walkways and installation of solar streetlights to make waka easy and safe for residents.
Di first round of di work suppose finish within six months.