OBODO NAIJA

AAU Lecturer Kpai Inside Hotel Room For Edo State

todayOctober 8, 2026 10 2 5

Background
share close

By: Mariam Ajayi

One senior lecturer for Ambrose Alli University, Ekpoma, Dr. Matthew Uwuigbe, don kpai inside one hotel room for Edo State after e reportedly lodge with one 21-year-old woman.

Police say di woman comot go buy water for am, but when she come back, she see di lecturer kpai for di room and raise alarm, as police don arrest her, di hotel owner and manager for investigation.

AAU don confirm say Uwuigbe na dia academic staff, but di university say di incident happen outside school and di 21-year-old woman no be AAU student.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds