By: Mariam Ajayi
Accord Party presidential candidate, Gbenga Olawepo Hashim, don tok say petrol no suppose pass ₦605 per litre if Accord enter gornment.
Hashim say ₦605 go be di sustainable start price, and with time, petrol price fit drop reach as low as ₦200 per litre.
E insist say cheap petrol no go affect government revenue or money wey dey enter FAAC.
Di Accord candidate, wey oppose removal of petrol subsidy, describe di earlier reason wey government give for subsidy removal as accounting magic.
E say Naija suppose first calculate di real cost to produce, refine, transport and distribute petrol before dem use international market price to determine how much country pipo go pay.
Hashim say selling petrol above di genuine cost of production and distribution should not automatically be described as subsidy loss.