OBODO NAIJA

ADC Chieftain Tell Wike to Warn Kuje Chairman Over Threat

todayAugust 26, 2026 3

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

ADC chieftain, Okai Austin, don ask FCT Minister Nyesom Wike to caution Kuje Area Council Chairman, Samuel Shekwolo, over comments wey e describe as dangerous and divisive.

Okai make di call on Wednesday for Abuja after one viral video allegedly show Shekwolo threatening to deal with people wey dey criticise am for social media.

Di Kuje chairman also allegedly tell residents wey no support APC to comot from di area council.

Okai say such talk fit cause serious political tension and violence if authorities no act quickly.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds