Olumide Akpata tok say pipo wey wan succeed for law must sabi build strong argument and convince pipo, as AI no fit replace human courtroom skills.
Akpata, wey be di 30th President of NBA, tok dis for Port Harcourt for di NDDC 2026 Moot and Mock Trial Competition for law students across Niger Delta universities.
E commend NDDC for di competition and tell universities to establish moot courts to help law student build confidence and beta prepare for di profession.
Akpata tok say even as technology and AI dey grow, di ability to stand for court and argue against something wey pipo ,no expect na skill machine no fit give lawyer.