Politics

APC Don Ready For 2027, Say Campaign No Go Be Fight fight

todaySeptember 10, 2026 1

Background
share close

By: Ayobami Dada

APC Presidential Campaign Council don talk say dia 2027 campaign no go be about dragging or insulting pipu, but dem go face issues and wetin Presido Bola Tinubu gornment don achieve.

Na di council Director-General, Senator Abdulazeez Yari, tok dis one for Gusau on Wednesday after e meet Zamfara Gofnor Dauda Lawal and some traditional rulers for di state. Yari say Naija don see plenty wahala wey make pipu dey wonder whether di country go survive, but Nigerians still hold boby together to make sure say Naija remain one counrty.

Yari say Tinubu love Naija and dey serious about developing di country, add say if APC get another chance to rule, di party go tell Nigerians clearly wetin dem wan di for di country.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds