Nigerian Armed Forces don begin investigate to know wetin really hapun wey lead to di kpaing of one NYSC Corper for Dei Dei, Abuja.
Defence Media Operations oga, Michael Onoja, na im tuk dis one for Thursday during dia monthly briefing for Defence Headquarters, say dem go make sure say dem release di result when dem finish di investigation.
Onoja still tuk say support wey come from United States don really hellep Nigerian Armed Forces work beta.
E say di help include, beta intelligence sharing, training, and capacity building for di troops.