By: Esther Ayoola
Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) like dis don reject Naija gornment agreement with UK to create branch of Coventry University for Naija.
Im tuk dis one on Monday during public lecture wey ASUU Sa’adu Zungur University branch organize for Bauchi state.
Piwuna say dem nor want any Coventry University branch for Naija because e fit spoil Nigerian university system.
According to di ASUU oga, say e no fair say Nigerian students dey struggle to get UK visa, but on di flip side UK schools dey try open campus for Naija.