News-auth

322 Results / Page 27 of 36

Background

Lagos

Lagos Police Kramp Two Traffic Robbers

By: Esther Ayoola Unto securioty doings, like dis, lagos police comand  don kramp two suspected traffic robbers for same place wia one woman blow alarm say gang dey wori pipo for ojota-ketu road, just one day ago. Di women, bin package message send directly to di Lagos Police Public Relations Officer, via X, SP Abimbola Adebisi, She yarn say four boys rush her car for ojota bridge for broad daylight, […]

todayDecember 10, 2025 13

obodo oyinbo

US FDA Launch Big Probe Into Reported Covid Vaccine Deaths

By: Esther Ayoola Di US Food and Drug Administration don open one mata dey touchlight deaths of US citizens, wey some people claim fit relate to Covid-19 vaccines. According to report, Since Presido Donald Trump appoint Health Secretary Robert F. Kennedy,  US gorment  big overhaul of vaccine policy, and dis move don raise worry among medical experts. Kennedy tuk tuk persin  Andrew Nixon tell tori pipo  say, FDA dey run […]

todayDecember 10, 2025 16 7

Lagos

Lagos Gorment Tell Civil Servants To Follow Computer Law

By: Esther Ayoola Unto computer movement, di lagos state don remix di 2025 public service rules, say dem no wan civil service wey dey drag leg again for this modern world. Head of service, Bode Agoro, nai tanda gigigba  yesterday dey tell state  workers say di old 2015 law book don old to run mata for modern time, and dat e no fit handle today digital speed and global standards […]

todayDecember 10, 2025 7

National

Vice Presido Shettima Clear Tinubu Security Doings

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido Kashim Shettima don align marras say, president Bola Tinubu nor dey security matter play at all at all. Oga vice dey yan dis one for inside  NISS 18th executive intelligence management course crew for him office for abuja. Say, na about 78 guys including  commandant joseph odama, ni come  drop their final course report for VP. Shettima carry the report, yan say government dey […]

todayDecember 10, 2025 16 1

Lagos

Three Die As Three Motor Jam Demselves For Lagos-Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Wahala nor dey finish, say another one don burst for Lagos Ibadan express way  wia three motor jam demselves, three people  kpai on the spot  and plenty others dey hospital dey take treatment. Lagos state traffic management authority (LASTMA) confamate give tori pipo say the accident spoil things for the area. The koko happen near secretariat, as people dey waka go Otedola bridge, traffic jam choke everywhere. […]

todayDecember 10, 2025 3

National

Senate Raise Alarm Say WAEC Wan Stress SS3 Students

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for  di Nigerian Senate, say Naija education  dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of  curriculum and  dat, SS3 students wey  go register for the exam go  write subjects wey dem never even see. Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis  […]

todayDecember 10, 2025 7

Niger Delta

Obi: Naija No Suppose Dey Poor, God Already Bless Us

By: Esther Ayoola Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources  wey dey under our foot and wey dey for sky. E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people […]

todayDecember 9, 2025 9

National

President Tinubu Clear Nigerian Aprokos To Stop Fake News

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu, unto doings don  tell Nigerians make dem try to dey talk truth all the time  and stop to spread fake news. He talk this through  information Minister Mohammed Idris  during the launch of the “my nigeria, my responsibility” program for inside the obodo Nigeria. Idris  say,  Nigerians must promote correct information and show the world the countri progress, peace, and national values.

todayDecember 9, 2025 8

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Esther Ayoola For Abuja,  after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu,  madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed […]

todayDecember 9, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app