News-auth

697 Results / Page 38 of 78

Background

National

Court Fix Jan 22, 2026, To Start Sowore Defamation Trial

By: Esther Ayoola Justice Mohammed Garba Umar of Federal High Court for Abuja don fix January 22, 2026, to start trial of di AAC presidential candidate for 2023 election, Omoyele Sowore, say im allegedly do criminal defamation of President Bola Ahmed Tinubu. Department of State Services, DSS don earlier file five-count charge for September 2025 against Sowore, plus X Corp and Meta, say dem allow post wey call Tinubu “criminal.” […]

todayJanuary 20, 2026 4 1

National

Vice President Shettima Explain Why Im Open Naija House For Davos

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don explain why im go open di Naija House for 2026 World Economic Forum (WEF) for Davos, say, na to hellep Naija show seriousness for global economy. Him yarn say di pavilion na historic step wey go make Nigeria no dey siddon look, but dey waka actively for international economic matter. Shettima tuk plenty give tori pipo, afta di opening say,  Nigeria House […]

todayJanuary 20, 2026 11

Lagos

Lagos Doctor Land Jail For Giving Fake Report

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment say, one doctor from Lagos don land prison dat, im go give fake medical report to hellep internet personality, Adetoun Onajobi, aka @justadetoun, Say e wan bin save her from police arrest. State Attorney General, Oluwasina Ogungbade, SAN, confirm di tori for statement wey dem share for X. From report, dem dey accuse Adetoun of plenty oppression and di use of bad language online […]

todayJanuary 20, 2026 4 9

Lagos

Sanwo-Olu Knock Residents Wey Risk Life Scoop Fuel For Apapa Bridge

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say, belle nor sweet am dat some residents dey risk dia lives unnecessarily, go scrap fuel, for road because say tanker fall for Liverpool Bridge, Apapa, say, dat kin of doings, nor make brain at all, at all. Di govo tuk with tori pipo for di state capital yesterday dat, gorment  no  dey play with safety of Lagosians life. E  praise di  […]

todayJanuary 20, 2026 10 14

Lagos

Govo Sanwo-Olu Accuse NGOs Say Dem Dey Cash Out From Makoko Demolition

By: Esther Ayoola Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don send accusation to local and foreign Non Gorment Organizations say, dem dey use di Makoko demolition mata take cash out and dat evidence full ground. Im put dis one for tori tuks with news waka waka dem, say, di state carry out di demolition for di safety of di people, because many houses dey under high-tension cable. Sanwo olu […]

todayJanuary 20, 2026 9

National

AICAN Contractors Block Ministry of Finance Over ₦4 Trillion Gbese

By: Esther Ayoola Indigenous contractors wey dey under All Indigenous Contractors Association of Nigeria (AICAN) don block Federal Ministry of Finance for Abuja on Monday. Dem dey protest say gornment never pay di over ₦4 trillion wey dem suppose pay for work wey contractors don finish. AICAN presido, Jackson Nwosu, break di mata for protest ground say dem dey face wahala like debt, say pipo wey dem dey owe dey […]

todayJanuary 19, 2026 9 1

National

VP Shettima Open Nigeria Business Meeting Centre For Davos To Collobi Investors

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don officially open Nigeria House for Davos as 2026 World Economic Forum (WEF) start for Switzerland, tuk say e go hellep attract investors enta Nigeria. He explain say na di first time wey Nigeria go get House for Davos to show di country economic opportunities. Shettima add say Nigeria House go serve as hub wey investors fit meet, discuss business, and make partnership […]

todayJanuary 19, 2026 2

National

Ilorin Enter Mourning As Chief Imam Shaykh Solih Kpai For age 75

By: Esther Ayoola Di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don announce say di Chief Imam of Ilorin, Shaykh Muhammad Bashir Imam Solih, don kpai  early mormor at di age of 75. Di Emir share dis report with tori pipo on Monday afternoon  say dem receive di news with total shock. He describe di late Chief Imam as a man of wisdom, honesty, loyalty and strong dedication to Islam and […]

todayJanuary 19, 2026 4

National

FG Drop New Housing Plan to Tackle Naija Housing Wahala

By: Esther Ayoola Federal Gornment don drop new national housing plan wey go focus on land reform, urban renewal and public–private partnership to tackle Naija housing wahala. Housing Minister Ahmed Dangiwa yarn dis one for Ilorin during di 14th National Council on Lands, Housing and Urban Development meeting. According to am, Nigeria housing problem na based say everybody dey rush come city, population increase nor be here, and high cost […]

todayJanuary 19, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app