News-auth

1027 Results / Page 37 of 115

Background

National

How President Tinubu Promise To Hellep Girl Child

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu say gornment nor go look anybody face, dat dem go continue to  create environment wey go allow Nigerian girls learn wella and women prosper. Baba Seyi dey yarn dis one for di celebration of International Women’s Day 2026 for X handle. Tinubu say, gornment go support programmes wey go give women more opportunities to shine for both obodo Naija and obodo […]

todayMarch 9, 2026 5

Lagos

Omo Onile Demolish 50 Houses For Surulere, Lagos; Residents Cry Out

By: Esther Ayoola For Surulere, Lagos, say some suspected land grabbers wey pipo sabi as Omo Onile don demolish about 50 houses, making pipo homeless. Dat di jaguda boys just waka enter di community on Tuesday, 27 January 2026, dey demand between N15 million and N25 million from house owners. Say Pipo wey no fit pay, na dia houses dem don demolish. Founder and Chief Executive Officer of Oikus, Israel […]

todayMarch 9, 2026 8

Lagos

Woman Kpai, Six Wunjur For Gbagada Bus Askident

By: Esther Ayoola Say One woman kpai and six odas get serious wunjury inside one askident wey hapun for New Castle Bus Stop, inward Gbagada, along Oworonsoki-Apapa Expressway, Lagos. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk, tuk, Adebayo Taofiq, di askident hapun over di weekend. Say na one Volkswagen commercial bus lose control come crash against roadside culvert. Di hardness of the jamming na make di woman fly […]

todayMarch 9, 2026 2

Lagos

APC Jandor Drag Gorment To Tackle Poverty

By: Esther Ayoola APC governorship aspirant for Lagos, Olajide Adediran, wey pipo sabi as Jandor, don give promise say him go take care of poor pipo, if e win for 2027. E yarn dis one on Saturday as e dey yarn with journalists for di 8th Annual Ramadan Lecture wey hold for Ikeja. Jandor say gornment main work na to beta people life, and dat im go work hard to […]

todayMarch 9, 2026 5

Lagos

IGP Disu Give Order To Police To Stop Over Sabi Work

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Tunji Disu don order make dem reduce di number of police tactical teams wey dey operate across Naija. Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh na im relate dis mata for Abuja when police commissioners gather for meeting with di Inspector-General of Police Tunji Disu. Say, di order na part of di reforms wey di Naija Police Force dey do to improve professionalism, accountability and […]

todayMarch 9, 2026 6

Lagos

NDLEA Gbab Former-Lagos Councillor With 40kg Skunk For Ibeju-Lekki

By: Esther Ayoola Naija Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, operatives don go gbab one former councillor for Lagos State, Sadiq Olalekan, for drug mata. Tuk, tuk of NDLEA, Femi Babafemi, Say dem pick di 45-year-old man for im house for Ilado area of Ibeju-Lekki afta dem receive correct intelligence informate. According to di NDLEA tuk tuk person, when officers search di house, dem see about 40 kilograms of skunk wey […]

todayMarch 9, 2026 3

Sports

Crystal Palace Carry Head Enter Conference League Last 16

By: Esther Ayoola Crystal Palace don show beta character enter UEFA Conference League last 16, beating Zrinjski Mostar 2-0 for Selhurst Park. For first leg, dem draw 1-1 with di Bosnian team. Maxence Lacroix and Evann Guessand ni score di goals wey carry dem through. According to report, Dis win sef, dey timely, as e hellep to relieve pressure for coach Oliver Glasner, wey don tuk say e go leave […]

todayFebruary 27, 2026 11

Sports

Arthur Okonkwo Get Clearance To Play For Super Eagles

By: Esther Ayoola Wrexham goalkeeper Arthur Okonkwo don get clearance from FIFA to play for Naija. According to report, di 24-year-old fit now join Super Eagles for di March international window tournament wey go shelle for Amman, Jordan. Na Iran dem go play first on March 27, den Jordan four days later for Amman International Stadium. Okonkwo clearance dey land just as first-choice goalkeeper Stanley Nwabali waka comot im club […]

todayFebruary 27, 2026 7

Sports

Super Eagles Coach Chelle Explain Why Im Ask For $130k Salary

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Éric Chelle, don defend why e dey ask Naija Football Federation (NFF) for $130,000 pay raise. Right now, him dey collect $50,000 per month, however, Chelle dey say di $130,000 no be just for him own pocket, e go also help pay him five-man technical staff, including assistant coach, physical trainer, goalkeeper coach, and personal assistant. E sti say today players dey need special […]

todayFebruary 27, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app