News-auth

697 Results / Page 54 of 78

Background

National

Minister Of Information Declare Say Tinubu Reforms Wan Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Information and National Orientation Minister, Mohammed Idris, tuk say dis year budget na to make sure President Bola Tinubu reform dem dey yield better result. Idris yarn dis one for one ogbonge paper, wey dem call “A Defining Moment for Nigeria: Why Staying the Course Matters.” E tuk say di budget na to support wetin dey work and make sure plenty Nigerians fit enjoy better life faster. […]

todayJanuary 6, 2026 10

National

Ondo Govo Ginger Im Mehn To Deliver Key Projects

By: Esther Ayoola Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, enter area oh dey ginger mehn for all ministries, departments and agencies say make dem show workings, deliver projects and programmes wey people dey expect. Him yarn dis one on Monday for Ondo First Working Day Prayer Meeting for 2026 for Governor’s Office, Akure. Governor Aiyedatiwa sha beg citizens make dem support government by dey patriotic and responsible.

todayJanuary 6, 2026 9

Lagos

Lagos Pastor Nor Show Face For Police Station Over Rape Case

By: Esther Ayoola Police say Senior Pastor of Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, no honour invitation wey dem give am to report on Monday by 10am for State CID, Panti, Lagos, over alleged rape and other offences. Police Public Relations Officer, Abimbola Adebisi, tuk on Sunday say di invitation na order from Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, afta several complaints reach police. According to police, dem invite […]

todayJanuary 6, 2026 15

National

INEC Arrange Mehn For Voters Registration

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission (INEC) don resume nationwide voter registration again and say dis na di second phase of Continuous Voter Registration for di obodo Naija. Chief Press Secretary to INEC chairman, Na Adedayo Oketola, confirmation dis particular mata give tori pipo on Monday Dis new phase come afta the first round of CVR wey end officially on December 10, 2025. INEC dey ginger say Nigerians […]

todayJanuary 5, 2026 7 6

National

FG Roll Out New Plan To Stop Exam Malpractice

By: Esther Ayoola Wi Federal Government don roll out new plan to fight mangomango for WAEC and NECO exams starting from 2026. Di announcement drop on Monday for Abuja, as Education Minister Maruf Alausa and Minister of State Professor Suwaiba Ahmed troway di mata comout. Dem tuk say di new move go tighten monitoring from start to finish and block every backdoor wey pipo dey use cheat for exams. Government […]

todayJanuary 5, 2026 11 2

National

President Tinubu select For Senator Magnus Abe Chairmo Of NUPRC

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don nominate former Senator, Magnus Abe as chairmo of di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC), plus 20 other pipo for boards of key oil agencies. Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk  for statement on Monday say Abe go lead NUPRC board together with other non-executive commissioners like Paul Jezhi and Sunday Babalola. Tinubu also nominate […]

todayJanuary 5, 2026 7

Lagos

Lagos Police Face Accusation Say Dem Collobi Sombodi ₦3.3M

By: Esther Ayoola Say accusation reach Police officers for Area H Command, Ogudu Lagos, head dat dem collect about ₦3.3 million ($2,000) from one couple wey dem wrongfully arrest early mor mor, for December 18, 2025. Some independent investigators ni touchlight dis mata dey tuk say afta di mata trend for X, di police return ₦2.2 million but dey beg make dem keep ₦1 million, say di money dem don […]

todayJanuary 5, 2026 10 10

obodo oyinbo

US Commandos Grab Maduro, Carry Am Go New York Court

By: Esther Ayoola Dem don carry comot former Venezuela president, Nicolas Maduro, reach New York court on Monday, few days afta US military grab am for Caracas. US say dem arrest am and him wife, Cilia Flores, because of drug trafficking case. Soldiers use helicopter, fighter jet and navy take dem comot Venezuela on Saturday. Meanwhile, interim leader Delcy Rodriguez don soften stance and tuk say she fit work with […]

todayJanuary 5, 2026 4 4

National

Sowore Drag Mata Say New Tax Law Go Suffer Pipo

By: Esther Ayoola Di 2023, African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don raise concern say Nigeria new tax reform no good for poor pipo. Sowore dey tuk for TV sitdon tuk, Nigerians don already suffer well-well and adding more tax go only make life harder for dem. Sowore say government suppose focus on bringing more pipo into di tax net instead of taxing pipo wey already dey manage […]

todayJanuary 5, 2026 8 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app