News-edi 1

1469 Results / Page 28 of 164

Background

Sports

CAF Arrange Malian Referee For Super Eagles Vs Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Say confederation of African football, don appoint Malian referee Boubou Traore say make im take di centre stage as Super Eagles of Nigeria go face Carthage Eagles of Tunisia for dia Group C match for 2025 AFCON wey go happen for Complexe Sportif de Fès. Traore na well-respected referee for Africa, while Senegal own Issa Sy go handle VAR. Super Eagles don start dia campaign well with […]

todayDecember 26, 2025 52

foreign

Palestine Economy Crash Sake Of Gaza War

By: Rilwan Agbomeji Palestinian Central Bureau of Statistics and Palestine Monetary Authority talk am for dia 2025 Palestinian Economic Monitor report wey dem release dis year for Ramallah. Dem say economy crash because Israel war for Gaza, tighter movement and trade restriction for West Bank, and money from inside and outside don dry, wey make govment no fit pay basic bills. According to di report, GDP for Gaza fall 84 […]

todayDecember 26, 2025 10

National

NLC Tell Nigerians To Reject Fake Tax Laws

By: Rilwan Agbomeji Di Nigeria Labour Congress just area dey ginger Nigerians make no body gree for any tax law wey magic don enter, wey dem nor understand. Un top yanings with tori pipo for Abuja, NLC President Joe Ajaero talk say such tax policies  dey make pipo trust for gorment. E stress say tax justice mean say di rich must pay dia fair share and all unfair taxes against […]

todayDecember 26, 2025 7

National

PDP Drag FG As US First Break News Of Sokoto Terror Strikes

By: Rilwan Agbomeji Di Peoples Democratic Party don bash Federal Govment for how e allow United States release news of terror strikes for Nigeria before Nigerian authorities yarn anything. In a statement issued on Friday, di PDP National Publicity Secretary, Ini Ememobong, PDP talk say di govment delay make Nigerians dey depend on foreign sources for updates about critical security operations for dia own country. Di US first announce dia […]

todayDecember 26, 2025 8

National

Sheikh Gumi Raise Alarm Say Us Airstrike Fit Scatter Nigeria Sovereignty

By: Rilwan Agbomeji Reaction don dey trail US work for Nigeria, Islamic cleric Sheikh Ahmad Gumi don knock US airstrikes for North-West Nigeria, say e fit cause wahala and spoil Nigeria sovereignty. Dis one come afta President Donald Trump talk say US forces bomb ISIS camps to protect Christians, as Nigerian government confirm say dem dey cooperate with America on security marras. Gumi say fighting terrorists na Islamic duty, but […]

todayDecember 26, 2025 6

Lagos

Lagos Fire: China-Returnee, Others Still Dey Miss

By: Rilwan Agbomeji One China-based clothier wey dem dey call Obum and three other traders still dey trapped under rubble afta fire don destroy Great Nigeria Insurance House for Balogun Market, Lagos Island. Di plaza dey popular for cloth and shoe market for both pikin and adults. Fire start for fourth floor, spread reach sixth floor, then waka go oda floors and nearby buildings. Konfam report on Thursday see say […]

todayDecember 26, 2025 16

Sports

Super Eagles, Tunisia Set For Hot AFCON Fez Showdown

By: Rilwan Agbomeji Say tickets for Nigeria Super Eagles group match against Tunisia for fez stadium dis Saturday, say don sold out, for tournament wey pipo dey complain of low attendance. Nigeria beat Tanzania 2–1 for dia first match, while Tunisia take Uganda 3–1, so both teams get three points each. Winner for dis fez clash go almost secure qualification enter round of 16.  

todayDecember 26, 2025 15

foreign

Bolsonaro Undergo Successful Hernia Surgery Afta Prison Transfer

By: Rilwan Agbomeji Former Brazil Presido, Jair Bolsonaro wey dey serve 27 years jail term for attempted coup don do hernia surgery and dem say e successful. Dem carry am comot prison on Wednesday go DF star hospital for Brasília, na im first time e dey out since November. Im wife Michelle talk say operation go well, no wahala, and dem dey wait make e wake from anaesthesia. Doctors talk […]

todayDecember 26, 2025 8

National

Police Burst Kidnap Plot For Benue, Save Man For Christmas Day

By: Rilwan Agbomeji Benue state police command like Jakie chan don rascal some jaguda boys wey bin plan to spoil  Christmas day, kidnap one man and say dem don rescue di man, Geoffrey Akume. Police tuk, tuk, DSP Udeme Edet, talk say di incident happen early mor mor for Tiortu area along Gboko/Makurdi road. According to police, di man dey travel from Gboko go Makurdi when armed men stop am. […]

todayDecember 26, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app