News-edi 1

2334 Results / Page 29 of 260

Background

Politics

Ekiti 2026, APC Chairmo rake full newspaper Say Oyebanji Re-election Na Done Deal

By : Jolayemi Olajide APC National Chairmo, Prof. Nentawe Yilwatda, dey rake oh, say the party get full numbers and power to win the Ekiti gofnorship election on June 20, plus the 2027 presidential mata. Yilwatda yarn dis one during di time e hand over di party flag give Gofnor Biodun Oyebanji for Abuja to take run for second term. E praise Oyebanji, say di governor dey work hard to […]

todayJune 11, 2026 10

Politics

Seriake Dickson Beg NDC Aspirants Wey Dey Vex Over Primary Election Gbege

By : Jolayemi Olajide Di National Leader of Nigeria Democratic Congress, Senator Seriake Dickson, don beg all the aspirants wey dey vex because of the scatter-scatter wey hapun for their recent primary elections. Dickson yarn dis one for TV down, say he know say di arrangement no too hold water, but make dem chillax, say na for di greater good of all. E explain to di once wey dey vex […]

todayJune 11, 2026 8

Sport Yarns

Roberto Martinez Hail Eric Chelle, Say Him Workings Dey Show 

By : Shalom Ovie Portugal coachie,  Roberto Martinez, don talk say e dey impressed with Super Eagles coachie, Eric Chelle, as e dey build im own football style for Nigeria side. Martinez talk dis one for him pre-match interview before di match, say Nigeria na strong side and Chelle don give dem clear football identity wey dey show. Even though some key players no dey, Martinez still talk say Nigeria […]

todayJune 11, 2026 8

south west

Stage Collapse For Inside Osun State as Adeleke Dey Do Rally

By : Jolayemi Olajide For Inside Osun State, fear gbab everybody on Wednesday, as di stage wey Osun State Govo, Ademola Adeleke and other big men dem dey use for rally burst enter ground for Ijebu Jesa. Dis particular gbege dey for inside 30 seconds video wey tori pipo collobi during di rally. Inside di video, musicians still dey perform for stage when di MC wan announce di next thing […]

todayJune 11, 2026 6

Politics

Bashir Ahmad throw jibe on Obi And Kwankwaso say dem Go still commot NDC

By : Jolayemi Olajide Bashir Ahmad don throw jibe for Peter Obi and Kwankwaso, make dem chest am, say if thins nor go as plan, dat dem go sti comot Nigeria Democratic Congress after di 2027 election Im post for X say the duo just dey look NDC as commercial vehicle to take enter power. According to am, party leader Seriake Dickson dey play long-term for 2031, why Obi dem […]

todayJune 11, 2026 8

Entertainment

Davido Carry Oyo Kidnap mata to FIFA Stage

By : Jolayemi Olajide Afrobeats superstar Davido don carry Naija security mata enter global level, as im use di FIFA World Cup countdown concert to tell Nigeria gorment to go an rescue the students and teachers wey bandits pack for Oriire LGA, Oyo State. OBO rock one bad black leather jacket wey full with green buttons, and every single button carry the name of the victims to show di world […]

todayJune 11, 2026 8

Sports

Portugal Beat Super Eagles

Nigeria super eagles fall hand and leg go  lose 2-1 to Portugal for international friendly match. Pedro Neto open naim open di scoring for Portugal before Akor Adams equalise for Super Eagles to make am 1-1. Later, substitute Francisco Conceição bend one fine shot enter net to restore Portugal lead and seal di win. Di result mean Portugal go enter di World Cup with back-to-back victories.

todayJune 11, 2026 11

obodo oyinbo

US, Iran Exchange Blow

US Presido Donald Trump, don cut chain say United States go hit Iran “hard” again after both sides exchange strikes overnight. Di white house presido put dis one for X, say dis action na based on say Iran go shoot down US Army helicopter. Iran President Masoud Pezeshkian respond for X say Iran go stand firm against any pressure or threat from America, showing say dem no go back down. […]

todayJune 11, 2026 10

OBODO NAIJA

Bad Boys Storm Kogi, Kpai School VP, Kidnap Students

Armed bad boys don storm Iluke community for Kogi on Wednesday morning, kpai three people join school VP. Di gunmen operate for hours, dey shoot scatter-scatter to tension di whole town. Dem come pack students wey wan write WASSCE English paper run enter bush. Residents don enter heavy mourning, dey beg government for sharp-sharp security help to rescue di kids.

todayJune 11, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds