News-edi 1

1366 Results / Page 29 of 152

Background

National

Rivers Govo Fubara Katapot From Pdp to Apc

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don catapot imself from di pipos democratic party to di All Progressives Congress on Tuesday. Di govo by imself, for imself and im pipo announce di move for Government House, Port Harcourt, just few days afta 17 PDP lawmakers also cross carpet to  di APC. Fubara say im even meet President Bola Ahmed Tinubu to inform am about wetin dey shelle for […]

todayDecember 10, 2025 8

National

Osun Govo Adeleke Join Accord Party

By: Rilwan Agbomeji Still on di politcal movement, Osun State Govo, Ademola Adeleke don finally comout with im full chest, say im don join Accord Party to pursue im re-election wey go shelle for  August next year. Governor Adeleke first confirmate  dis mata for im verified x page few days afta e resign from Peoples Democratic Party. For im unveiling as new member, Adeleke tuk say e don actually register […]

todayDecember 10, 2025 3

International

Zelensky Yarn Marras Say Im Ready Run Election If Ukriane Dey Secured

By: Rilwan Agbomeji Ukrainian Presido, Zelensky  don reply US President Donald Trump say,  e ready to run new election if only dem fit konfamate  sucurity and e go send new peace plan to Washington soon to try end dis four-year war wit Russia. Zelensky dey caput dis one afta e waka go plenty European country dey ask leaders how dem go take respond to US peace plan wey some people […]

todayDecember 10, 2025 4

Sports

NFF Promise To Pay Super Eagles Coachie Im Three Month Gbese Ahead Of AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella. Di […]

todayDecember 10, 2025 12

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Rilwan Agbomeji For abuja,  afta all di plenty drama for Osun state between di dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birthday message give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, Mama Remi  dey hail Madam Adeleke for di serious work wey she dey do to uplift Osun people through […]

todayDecember 9, 2025 10

Lagos

Lagos Apc Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Rilwan Agbomeji Lagos branch of di All Progressives Congress (APC) dey vex carry matter for head dat make opposition no dey disturb president Bola Tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC lagos tuk tuk, seye oladejo,  ni dey yarn dis one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow afta ADC yarn peter […]

todayDecember 9, 2025 7

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn […]

todayDecember 9, 2025 10 2

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,  […]

todayDecember 9, 2025 6

National

Atiku Yarn Matas Say Late Yar’adua Still Dey Inspire Naija

By: Rilwan Agbomeji Wi former vice-presido Atiku Abubakar betterlicious don thruway salute give wi late general,  Shehu Musa Yar’adua, say im still dey inspire politics for Naija. Im dey yanyanpu dis one for Abuja for inside union gathering, Atiku yarn say Yar’adua na correct mentor, brother-in-arms, and moral compass wey dey guide people even till now. Di former vice presido say,  Yar’adua legacy dey motivate Nigerians wey still dey believe […]

todayDecember 9, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app