News-edi 1

1469 Results / Page 29 of 164

Background

National

FG Explain Dia Role For US Security Airstrikes For Sokoto

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment say Nigeria dey continue security and intelligence cooperation with United States afta airstrikes hit terrorist targets for North West. According to statement wey Ministry of foreign affairs release on Friday, spokesperson Kimiebi Ebienfa talk say di cooperation don lead to precise airstrikes against terrorists. Ebienfa say Nigerian authorities still dey work with international partners, including USA, to tackle terrorism and violent extremism for di country. […]

todayDecember 26, 2025 5

National

US Bomb ISIS For Northwest Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Senior man, Presido Donald Trump of America say im and US soldiers don carry out deadly air strike against ISIS fighters for Northwest Nigeria. Im post dis one for im truth social media platform wia aproko pipo go pick di informate. E say dem go still attack again if di militants no stop killing Christians. For separate post, Defence Secretary Pete Hegseth thank Nigerian govment for dia […]

todayDecember 26, 2025 16

Lagos

Two Pipo Kpai As Tanker Blow For Badagry Expressway

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) omo don share update oh, say two people kpai for diesel tanker explosion wey happen for Badagry expressway, Oto-ijanikin axis near Lagos state university of education. LASTMA tuk tuk persin Adebayo Taofiq, explain say, di accident happen when di tanker driver dey try overtake anoda motor with too much speed and lose control. According to Taofiq, di tanker crash burst into […]

todayDecember 26, 2025 11

Sports

Super Eagles Train For Tunisia Inside House

By: Rilwan Agbomeji Unto to marras, say di Super Eagles go run small training behind closed door today, Thursday, with Christmas rice and chicken for di AFCON match against Tunisia. Team media officer, Promise Efoghe, yarn na troway di update say following di coachie, Eric Chelle order . Coach wan keep tactics and lineup secret as dem ready for AFCON 2025 clash.  

todayDecember 25, 2025 14 2

National

Politics Tuk Tuk Tell Opposition Parties To Bring New Face Or Forget 2027

By: Rilwan Agbomeji Politic tuk tuk, Dr. Hakeem Baba Ahmed don recharge wire call to di Africa Democratic Congress, say make dem bring fresh face and new ideas if dem wan gain trust of Nigerians ahead of 2027 elections. Na for TV sit don  tuk, di senior man yarn okpata  say, recycling old politicians and stories no go help, especially to win young people. E add say just calling demself […]

todayDecember 25, 2025 10

National

Presidency Deny Rumour Say Tinubu Change Chief Of Staff

By: Rilwan Agbomeji Presidency don deny report wey talk say President Bola Tinubu don change im Chief of Staff, Femi Gbajabiamila. Di rumour start afta some social media posts claim say Gbajabiamila don get replacement with Principal Private Secretary, Hakeem Muri-Okunola. But government talk say di story no correct and say na fake news. President Special Adviser on Information, Bayo Onanuga, beg Nigerians make dem ignore di false report.  

todayDecember 25, 2025 18

Lagos

Lagos State Govment Go Divert Traffic For Third Mainland, Obalende On Saturday

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment don sound alarm for drivers and commuters say make dem plan dia movement well well as some big roads for Lagos island go lock on Saturday sake of Eyo festival. Major routes wey go feel am include Third Mainland Bridge, Obalende and oda nearby streets around di Island. Government talk say di diversion na for small time, so as to make di colourful Eyo […]

todayDecember 25, 2025 23

Lagos

Govnor Sanwo-Olu Open Ogboni Iduntafa Palace

By: Rilwan Agbomeji Govnor Babajide Sanwo-Olu don officially open di Ogboni Iduntafa Palace and welcome di Eyo Ologede group for Lagos Island. Ogboni Iduntafa na one of di oldest and most respected traditional institutions wey come from Yoruba culture. Di palace stand as strong symbol of Lagos Island tradition, spiritual authority, community protection, and ancestral heritage wey don last for many generations.  

todayDecember 25, 2025 18

National

FG Send More Security Teams To Borno Afta Bomb Blast Kill Five

By: Rilwan Agbomeji Vice-President Kashim Shettima don talk say Federal Government go send more security tactical teams go Maiduguri, Borno State, afta terrorist attack wey happen for di area. Suspected terrorists bomb Al-Adum Mosque for Gamboru Market around 6pm on Wednesday, as people gather for prayer, and di blast kill five people while many others get injury. Shettima condemn di attack for im X page, say di incident na wicked […]

todayDecember 25, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app