News-edi 1

2334 Results / Page 31 of 260

Background

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo Go Corner dey Demand N5bn

By : Shalom Ovie Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public. According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra […]

todayJune 10, 2026 14

south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

By : Shalom Ovie Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live […]

todayJune 10, 2026 9

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Blow Whistle On Top Peter Obi Head

Popular Nollywoord Actor, Kenneth Okonkwo don come out clear marras say, he get duty to report any crime against di state wey come to him knowledge and that South-East pipo don too suffer. He yarn dis one for him X social media page on Wednesday say, no person suppose still dey take dem or any Nigerian citizen play or carry out wayo wayo without challenge. He say, Obunike na just […]

todayJune 10, 2026 16 2

Economics

IMF Raise Alarm Say Nigeria External Debt Fit Reach $72.6bn Before 2027 Election

International Monetary Fund (IMF) don warn say Nigeria public external debt fit jump by over $20 billion reach $72.6 billion by 2027. Dem talk say election year spending pressure fit make borrowing even worse. For dia 2026 Article IV report wey dem release on Tuesday, IMF show say Nigeria external debt go rise from $51.9bn for 2025, go $66.5bn for 2026, before e finally reach $72.6bn for 2027, that one […]

todayJune 10, 2026 20

Sports

Serena Williams Return with Big Win for Queen’s Club Doubles

Senior woman, Serena Williams don make ogbonge winning return to tennis for Queen’s Club doubles on Tuesday. Di American legend wey don win 23 Grand Slam titles team up with Canada teenage Queen, Victoria Mboko, and dem beat Erin Routliffe and Nicole Melichar-Martinez 7-6 (7/2), 6-2 for first round. Mama Sere, Sere, wey shock plenty pipo last week unto say, seh tuk say, she wan return to playing, say she […]

todayJune 10, 2026 7

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Backyard Movement

Baba Presido of America, Donald Trump drop one or two on Tuesday say hand go touch Iran, say e nor get wetin person go tell am,  hand go touch Iran say dem get mind shoot down one US military helicopter wey dey patrol near Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social on Tuesday say, im hear report say di attack hapun for night, even as dem dey try […]

todayJune 10, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve ₦10B Emergency Fund

Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues. Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di  disease. Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness. Dis task force, […]

todayJune 10, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment Set Compass To Rascal Ebola

Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don shake table drop micro soft word say Lagos State get strong doings in place to package Ebola. Im tuk dis one during Invest Lagos 3.0 event on Tuesday. According to am, even as COVID-19 loud reach for 2020, say e dey choir practice for Ebola mata, but dat, Lagos don package tools for di Ebola.

todayJune 10, 2026 10

Lagos

Lagos-Apapa Expressway Askident Kpai Minibus Driver

One commercial driver don lose im life for serious askident wey happen for Lagos-Apapa Expressway. Di gboza crash, involve commercial tuke tuke motor and Toyota Tundra. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk tuk person, Adebayo Taofiq, di driver wunjure wetin nor gud and im kpai for di spot because of di heavy impact. Authorities don begin investigate to know wetin cause di askident.

todayJune 10, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds