News-edi 1

2334 Results / Page 28 of 260

Background

OBODO NAIJA

Sowore Tell Presido To Resign

Still on same mata, na Omoyele Sowore carry protester dey protest for wi decision headquarters, say make wi oga presido resign. Di senior man fry, fry mouth unto many tins for di Democracy day protest wey dem do for Abuja. According Sowore, security zero, food sef nor dey, say, Nigerians don lost dia democracy and dey demand back from di gorment.

todayJune 12, 2026 9

Lagos

Falz, Femi Falana Join Protest For Lagos

Nigerian rapper, Folarin Falana ,AKA Falz di bad guy, sef join protesters for Ikeja Underbridge, Lagos, on Friday to demand action against rising insecurity, economic hardship and bad governance across di country. Di protest, wey im join alongside im papa, human rights lawyer Femi Falana, and other activists, organise, pin point say enough don dey enough and dat Democracy Without Security na zero Falz drop some bars during di protest, […]

todayJune 12, 2026 22

Sports

South Africa Finish With 9 Men 

Mexico don show workings, start dia 2026 World Cup journey with 2–kondo win over South Africa for opening match wey hapun for Estadio Azteca. Na so south Africa players eavy for ground, nor fit carry body for di game, na so Mexico take advantage, three red cards come out, make South Africa finish with nine players for field. Julian Quinones naim score di first goal for di tournament while Raul […]

todayJune 12, 2026 7

obodo oyinbo

Oil Price Crash, Iran Peace Deal

Oil price don drop on Thursday afta US Presido, Donald Trump soft in bicycle pedal from im earlier threat to launch more attacks on Iran, and tuk say dem don ready for peace agreement. Earlier for di day, tension bin rise like 40 years olg BP, as America and Iran exchange attacks for di second day, scata tins for di middle east. Later di day, e be like  Trump tuk […]

todayJune 12, 2026 11

OBODO NAIJA

Abike Dabiri-Erewa Complain About South Africa Attack

NiDCOM boss, Abike Dabiri-Erewa don condemn new xenophobic attacks wey dey hapun for South Africa, talk say “enough is enough” for di matter. She tuk dis on e for tv sit don tuk, say Nigeria go wait for higher authorities like Foreign Affairs Ministry and President before dem take strong decision on bilateral relationship. Dis one come afta gornment evacuate 258 Nigerians wey dey face violence and harassment, come back […]

todayJune 12, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Open Kuje Road

Wi oga Presido, Bola Tinubu don commission Federal Highway 105 wey connect Airport Expressway to Kuje for Abuja. Di seniorman presido run dis parrol through Vice Presido Kashim Shettima, saying di road na proof say dis gornment, na tuk na do gorment. Im come assure Nigerians say di administration go continue to complete ongoing infrastructure projects for di benefit of all.

todayJune 12, 2026 9

Lagos

Lagos Clean Up With International Mehn

Clean lagos, clean lagos, u dey feel say na play play, yesterday, lagos environmental pipo cary some senior mehn, show dem shegge, tell dem to clean. Dis na mehn wey dey in charge of international exchange, an dem  carry di senior exchange pipo go clean lagos Marina, to mark World Environment Day 2026. Di programme hapun in collabo with Lagos State Waste Management Authority and Recyclers Association of Nigeria to […]

todayJune 12, 2026 8

OBODO NAIJA

ISWAP Bomb Expert With One Other Leader Don Surrender

Army boys wey dey Operation Hadin Kai don catch two big names for ISWAP group afta di guys surrender give 159 Battalion for Geidam, Yobe State. Security analyst Zagazola Makama tuk dis one on Thursday say di two suspects, Ismail Mohammed and Abu Umar, drop dia weapons on June 8. Di Soldiers tuk say Abu Umar na special engineer wey sabi arrange car bombs and explosives for di terrorist group, […]

todayJune 11, 2026 8

OBODO NAIJA

Falana, Falz, Other Groups Declare Nationwide Protest

Different group networks, youth associations, and top activists don declare tomorrow Friday, June 12, as day for nationwide protest over hunger and insecurity for country. Di coalition, say di mass action na to show how pipo dey suffer for Nigeria with high cost of living, inflation, and bad economy. Big names like lawyer Femi Falana, musician Falz, Soweto, and others sign di statement, talk say Nigerians no get reason to […]

todayJune 11, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds