News-edi 1

1478 Results / Page 44 of 165

Background

Sports

Ndidi Go Captain Super Eagles After Troost-Ekong Retirement

Wilfred Ndidi don become Super Eagles captain for AFCON 2025 afta Troost-Ekong retire. Ndidi, wey don lead Eagles for 2026 FIFA World Cup African playoffs, na now im dey front line as di most senior padi for di team. Di 28-year-old Besiktas star don make 71 appearances since 2015, and then Moses Simon go dey back am up as assistant captain.

todayDecember 5, 2025 10

National

Imo Police Burst 2 Kidnappers, Nab 12

By: Rilwan Agbomeji Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest. DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again. Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for […]

todayDecember 5, 2025 12

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man […]

todayDecember 5, 2025 8

National

Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling

By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main […]

todayDecember 5, 2025 25

Sports

Troost-Ekong – Wetin Make Me Retire From Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, William Troost-Ekong don explain why e retire ahead of 2025 AFCON. Di 32-year-old defender wey don dey carry Naija flag for almost ten years don officially waka comot on Thursday, draw curtain on im international wahala. Even though Éric Chelle put im name for di provisional AFCON list, Ekong talk say e no go follow because na now im feel say time don reach […]

todayDecember 5, 2025 9

National

Obi Blast Campaign – Cars Dey Scatter, Priorities Dey Lost

By: Rilwan Agbomeji Labour Party 2023 Presidential Candidate, Peter Obi don drop mata for ground say di way all dis big politicians take dey spend money on top big big motor, na concern. Obi talk say for time wey Naija pipo neva chop, no gey job , dey fear kidnaping, ni senior political big names  dey spend public money buy big big motor for political campaign, say e no good […]

todayDecember 5, 2025 9

Lagos

Court Nab Man Wey Try Export Cocaine, Igbo From Lagos

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Lagos don order make dem dump one man, Uche Ezeh for Ikoyi Correctional Centre afta e confess say e try export 4.40kg cocaine and 11.50kg cannabis. Judge talk say e go siddon till December 12, 2025, until dem open di full gist, check all di facts, and drop final judgment for im head. NDLEA drag am for four-count charge, FHC/L/30/2025, and arraign am […]

todayDecember 4, 2025 14

Lagos

One Person Kpai As Jaguda Boiz Scatter Ground For Lagos

By: Rilwan Agbomeji At least one person don kpai afta heavy fight burst between suspected Aiye and Eiye cult members for Awoyaya, Ibeju-Lekki, Lagos. Di fight burst from Monday enter Tuesday, and before people know wetin dey sup, one guy wey dem sabi as Pelebe don kpai inside di cult gbege. Videos just dey show show bodi online how di wahala, take scatter pipo for Awoyaya . Di video show […]

todayDecember 4, 2025 7

Lagos

Temu Join Body With Dellyman To Run Deliveries Sharp-Sharp Across Naija

By: Rilwan Agbomeji Temu, di fast-growing global e-commerce giant, don link up with Lagos-based startup Dellyman to run deliveries across Naija, dey ready shake di whole market wella. Dis move follow afta Dellyman pilot run wey dem deliver over 1,300 packages with 95% success, show say dem fit handle heavy e-commerce gbege for anywhere for Obodo Naija. Since 2020, Dellyman don turn one of Naija most reliable same-day and last-mile […]

todayDecember 4, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app