News-edi 1

2593 Results / Page 43 of 289

Background

OBODO NAIJA

Bayelsa Police Don Arrest One 23-year-old University Student Wey Spread Fake Social Media News Say Bandits Don Invade Some Parts Of Di State.

Bayelsa Police don arrest one 23-year-old university student wey spread fake social media news say bandits don invade some parts of di state. Commissioner of Police, Daniel Iyamah, tok dis one on friday for Yenagoa, say di fake report cause serious panic and disturb business and school activities. According to am, di false story claim say militants catch di bandits and dey demand N50 million ransom before dem go release […]

todayJune 26, 2026 30

OBODO NAIJA

Kwankwaso Jam Obasanjo For Kano aliagn politics

Senator Rabiu Musa Kwankwaso pay courtesy visit to former President Olusegun Obasanjo for Kano on Thursday night. Obasanjo, wey dey Kano for official assignment, receive Kwankwaso for im temporary residence. Statement wey Saifullahi Hassan release say Aminu Gwarzo join Kwankwaso for di visit. Di statement no talk wetin di two leaders discuss during di meeting.  

todayJune 26, 2026 30

OBODO NAIJA

Check Food Label Before You Chop, NAFDAC Advise Nigerians

NAFDAC Director-General, Prof. Mojisola Adeyeye, don tell Nigerians make dem dey read food label before dem buy any packaged food. She tok dis one on Friday for Abuja during di launch of di "Read the Food Label" campaign, say bad food choice dey increase sickness wey no dey spread. According to am, di campaign go help people understand wetin dey inside di food wey dem dey buy and make better […]

todayJune 26, 2026 19

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve Computer Health For Nigerian

President Bola Tinubu don approve di creation of National Health Technology and Data Analytics Office to coordinate Nigeria digital health system. Dis na according to statement from  Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, naim on Friday. According to di statement, di new office go operate under di Office of di Coordinating Minister of Health and Social Welfare.    

todayJune 26, 2026 23

Sports

Mourinho Back England To Win 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh Real Madrid coach Jose Mourinho drop micro soft word  say England get strong chance to win the 2026 FIFA World Cup. Mourinho tell Beast Mode On Podcast say e believe England get the quality to carry the World Cup trophy. England start dia campaign with 4-2 win over Croatia before dem play 0-0 draw with Ghana for Group L. Dem go play Panama for dia final group […]

todayJune 26, 2026 54

Sports

Ecuador Surprise Germany 2-1

By: Yusuf Abuh Unto world cup updates, Ecuador  shock Germany 2-1 for dia last Group E match on Thursday to qualify for World Cup last 32. Germany naim score first through Leroy Sane, but Nilson Angulo equalise before Gonzalo Plata score di winning goal with 13 minutes remaining. Di victory give Ecuador four points, enough to enter di knockout stage as one of di best third-place teams. Ivory Coast too […]

todayJune 26, 2026 25

obodo oyinbo

Venezuela Earthquake Kpai 188 Pipo As Of Thursday

By: Yusuf Abuh Death toll from di strong earthquake wey shake Venezuela don rise reach 188 people, while 971 pipo don sustain injury, according to government officials. Dem say about 30 aftershocks don hapun since di two big earthquakes of 7.2 and 7.5 magnitude hit di country on Wednesday. Di disaster make plenty buildings for Caracas collapse and force authorities to close di main airport as rescue workers still dey […]

todayJune 26, 2026 26

OBODO NAIJA

Shettima Order NEMA To Prepare For Flood

By: Yusuf Abuh Vice-Presido, Kashim Shettima don direct National Emergency Management Agency, NEMA, and other gornment agencies make dem start work for  flooding now, make e nor con spoil something later. Di senior man vice presido give dis order on Thursday during meeting with di emergency task force pipo for Aso Villa, Abuja. Dis one follow National Economic Council approval of N83.2 billion on June 18 to support plans wey […]

todayJune 26, 2026 23

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Oyo Hope

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure pipo for Oyo State say, make dem nor too worry demselves say goment go rescue di pikins and dia teachers wey kidnappers carry from three primary schools for Oriire Local Government Area. Baba Seyi tok dis one for Ibadan for wia im go run one or two parrol. Im say security agencies dey use every possible way, including support from […]

todayJune 26, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds