News-edi 2

1333 Results / Page 140 of 149

Background

Local

Lagos Confirm Say Dem Go End Sexual And Gender-Based Violence.

Di Attorney General and Commissioner for Justice for Lagos State, Lawal Pedro (SAN), talk say di Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) awareness programme no be only event, na to show say everybody dey gbekun to stop all kinds Sexual and Gender-Based Violence (SGBV). He talk dis one during di 2025 DSVA awareness programme wey happen for Oregun, Ikeja, Lagos. Pedro explain say, Sexual and Gender-Based Violence no fit stop […]

todayOctober 2, 2025 45

Local

MetroGoods Wey Worth Millions Naira Destroy As Fire Burn Lagos Market.

Swift intervention by Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA, stop wahala wey fit don big disaster after fire burst for Bariga Market. Plenty shops burn finish before emergency people show to stop fire from scatter more. Nobody still sabi wetin cause di fire. Di thing happen for Tuesday, and early findings talk say fire start for one shop, then waka fast enter other shops because many stalls get wooden partition. […]

todayOctober 2, 2025 42

National

Strike: FG Beg PENGASSAN Over Dangote Wahala, Truce Meeting Go Hold Monday

Minister of Labour and Employment, Muhammad Dingyadi, don beg PENGASSAN make dem calm down over the issue wey dem get with Dangote Refinery, say the Ministry don already dey work to bring both sides come roundtable make dem no allow the fight escalate pass this level. Inside one statement wey the Head of Information and Public Relations for the Ministry, Patience Onuobia, sign, Dingyadi talk say dem don already send […]

todaySeptember 29, 2025 31

National

Tinubu Fix October 6 As Deadline for NERD Compliance for NYSC Mobilisation

President Bola Tinubu don use him power under NYSC Act approve say every graduate gatz follow the Nigeria Education Repository and Databank (NERD) Policy before dem fit do NYSC or even collect exemption. This new rule wey dey inside Sections 2(4)(4) and 16(1)(C) of the NYSC law, na part of circular wey the Secretary to the Government of the Federation, Senator George Akume, don sign and send give everybody. According […]

todaySeptember 29, 2025 69

National

Give us Ibadan State before 2027 — Olubadan talk Tinubu

The new Olubadan, Oba Rashidi Adewolu Ladoja, don talk say make dem create new state wey go be Ibadan State. As e dey talk to people for Ibadan after Governor Seyi Makinde give am Staff of Office, Oba Ladoja ask President Bola Tinubu make e try make sure say Ibadan State dey before 2027. For Yoruba, Oba talk say, “My people don send message go Mr President. Mr President, dem […]

todaySeptember 26, 2025 33

International

UNGA 80: Tinubu No Show Fit Be Strategy – Trump Fit Embarrass Am For Nothing, Ex-NIIA DG Talk

Prof. Akinterinwa, former Director-General of the Nigerian Institute of International Affairs (NIIA), don talk say President Bola Tinubu absence from the 80th United Nations General Assembly (UNGA) for New York fit be strategic move to avoid any unnecessary embarrassment from former US President, Donald Trump. As e dey, Akinterinwa explain say even though Vice President Kashim Shettima represent Nigeria for the summit, him no dey on the same level with […]

todaySeptember 26, 2025 35

National

Alleged Terrorism: Court Throway Nnamdi Kanu No-Case Submission, Order Am Make E Open Defence

Federal High Court for Abuja don throway the no-case submission wey Nnamdi Kanu, self-acclaimed leader of the Indigenous People of Biafra (IPOB), file for him ongoing terrorism case. Justice Omotosho wey deliver the ruling on the matter talk say the Federal Government don show enough evidence wey suppose make Kanu enter witness box go defend himself. The judge talk say the evidence wey prosecution carry come court, plus the exhibits […]

todaySeptember 26, 2025 46

International

People waka comot as Netanyahu Deny say Gaza dey Suffer ‘Genocide’ and Hunger for UN Speech

Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, don deny accused say dem dey do “genocide” for Gaza or dey use “starvation” as weapon. He talk this one on Friday for United Nations General Assembly for New York. Netanyahu talk say instead of starving Palestinians, Israel dey even help feed people for the war-torn Gaza. According to am, “People wey dey carry fake story say Israel dey do genocide no better pass those […]

todaySeptember 26, 2025 25

Local

Construction workers trap inside Anambra three-storey building wey collapse

One three-storey building wey still dey under construction don collapse for Okpuno, Awka, Anambra State capital, near the Anambra State House of Assembly, off Ekwueme Square, around 11:40am on Thursday. The building wey get four suspended floors still dey for roofing stage when e suddenly fall, scatter everywhere, and throw people for the area into panic. People wey see as e happen talk say the building no give any sign […]

todaySeptember 26, 2025 32

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds