News-edi 2

1844 Results / Page 141 of 205

Background

National

Akpabio Don Tell DIA Make Dem Strengthen Global Partnerships

Senate President Godswill Akpabio don urge di Defence Intelligence Agency (DIA) make dem deepen bilateral and multilateral partnerships to strengthen Nigeria adaptive intelligence framework to tackle di evolving security threats. Akpabio talk dis one for Abuja on Monday during di opening of di Chief of Defence Intelligence Annual Conference 2025 wey get di theme, “The Role of Multi-Source Intelligence Innovation in National Security.” As Sen. Ahmad Lawan represent am, he […]

todayNovember 24, 2025 11

International

U.S Dey Urge Nigerian Government Make Dem Catch Di People Wey Kidnap Schoolgirls

Di United States don call on Nigerian government make dem catch di people wey dey responsible for di recent kidnapping of schoolgirls. Last Monday, November 17, 2025, for Government Girls Comprehensive Secondary School for Maga, Kebbi State, armed bandits carry away no fewer than 25 schoolgirls from dia dormitory. Four days later, di same armed people attack St Mary’s Girls’ School for Papiri, Agwara LGA of Niger State, abducting at […]

todayNovember 24, 2025 21

Lagos

Foundation Yarn Dem Go Protect Pikin Dem For Road, Make School Waka Safe

To address di wahala wey dey affect transportation for pikin dem wey dey go public schools, Gabriel Rotimi Aroge (GRA) Empowerment Foundation don promise say dem go provide safe transport alternatives for schoolchildren, even as dem never get enough support from expected donors, especially corporate organisations. Di founder, Gabriel Rotimi Aroge, talk dis one before di official launch of di free Cycle 2 School Plus (C2S+) programme, wey dey linked […]

todayNovember 24, 2025 15

National

Na Nigeria Dey Cursed, Or Na We Be Di Curse?” – Obi Lament Over Insecurity

Peter Obi, di 2023 Labour Party (LP) presidential flagbearer, don lament di serious yawa wey dey Nigeria over di rising insecurity across di country. Obi yarn for him official X account on Monday morning say, “Di past 10 days for Nigeria don show tori wey shock everybody, levels of chaos, insecurity, and institutional decay wey suppose disturb any leader conscience. Our country no dey go through dis wahala by fate, […]

todayNovember 24, 2025 22

National

Low Turnout, Tight Security As Kwara Church Hold Sunday Service

Despite fear and grief, Christ Apostolic Church, Oke Isegun, Eruku, Kwara State hold special Sunday service for inside dia blood-splattered auditorium, as dem dey pray for safe return of kidnapped members and repose of those wey die during Tuesday brutal bandit attack. The church on Sunday confirm say 38 worshippers don get abducted, against earlier social media claims. Church secretary, Michael Agbabiaka, talk say church first compile 35 names, but […]

todayNovember 24, 2025 21

National

ICYMI: 38 Kwara Church Worshippers Wey Gunmen Carry Away Don Regain Dia Freedom

Kwara State Governor, AbdulRahman AbdulRazaq, don announce say 38 people wey dem abduct during attack for Christ Apostolic Church (CAC), Eruku, Ekiti LGA, don regain dia freedom. Di announcement come from Governor press aide, Rafiu Ajakaye, on Sunday. Di governor yan say di release na because President Bola Tinubu personally oversee di rescue, even cancel im G20 South Africa trip to handle security wahala for Kwara and Kebbi. AbdulRazaq thank […]

todayNovember 24, 2025 18

Lagos

Lagos-Calabar Highway One Section Go Open For December 2025 – FG

FG don announce say first 47-kilometre section of Lagos–Calabar coastal highway go open for public use for December 2025. Minister of Works, David Umahi, yan this one during him inspection tour of di highway on Sunday. Umahi talk say di opening go happen between December 12 and 17, and both government and contractor dey committed to complete di 750-kilometre highway wey dey connect nine coastal states. Him add say government […]

todayNovember 24, 2025 16

Lagos

Lagos Dey Rally Investors For COP30

Lagos State Government don rally investors and development partners for di 30th Conference of the Parties (COP30) to di United Nations Framework Convention on Climate Change. Through di Office of Climate Change and Circular Economy, di state also push for eco-friendly transport and clean cooking solutions during di two-week conference wey hold for São Paulo, Brazil, wey end on Friday, November 21. COP30 bring global leaders together to develop new […]

todayNovember 24, 2025 14

Lagos

LASBCA Don Demolish Illegal Buildings For Lagos Island

Lagos State Government, through LASBCA, don demolish some illegal structures for Ikate Elegushi area because dem no get proper approval or authorisation. LASBCA Director of Public Affairs, Adu Ademuyiwa, talk say di joint enforcement operation happen on Saturday with Office of Urban Development and LASBCA, targeting buildings wey dey break building regulations and dey block drainage. Lagos State Assembly House Committee Chairman on Physical Development, Sylvester Ogunkelu, wey join di […]

todayNovember 24, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds